By Chidi Anthony Opara
Na waa for Naija politician dem.
Dem don begin dem waka,
Dem don begin dem talk.
All dem waka now,
All dem talk now
Na election waka,
Na election talk.
Dem don waka dis waka before,
Dem don talk dis talk before,
Dem don do dis gra gra before,
Dem don take dis wayo before
Collect di position dem.
Work di work,
Dem no work.
Comot for di work,
Dem no comot.
Dem dey busy
Like say something dey happen,
Like say something mega.
But country man
Know say nothing dey happen,
Say nothing mega for Naija.
Everyday dem dey form party.
Di party dem dey get friction,
After friction
Di party dem go form faction,
After faction
Dem go form fiction.
Na dis fiction
Dem go take wayo country people again.
Na dis fiction
Dem go take collect position dem again.
Work dem no go work,
Comot dem no go comot.
Dem go dey busy
Like say something dey happen,
Like say something mega,
But country man
Know say nothing dey happen,
Say nothing mega for Naija.
(This poem is presented as a social service, all rights reserved).
You received this message because you are subscribed to the "USA-Africa Dialogue Series" moderated by Toyin Falola, University of Texas at Austin.
For current archives, visit http://groups.google.com/group/USAAfricaDialogue
For previous archives, visit http://www.utexas.edu/conferences/africa/ads/index.html
To post to this group, send an email to USAAfricaDialogue@googlegroups.com
To unsubscribe from this group, send an email to USAAfricaDialogue-
unsubscribe@googlegroups.com
---
You received this message because you are subscribed to the Google Groups "USA Africa Dialogue Series" group.
To unsubscribe from this group and stop receiving emails from it, send an email to usaafricadialogue+unsubscribe@googlegroups.com.
For more options, visit https://groups.google.com/groups/opt_out.