(Nigerian Pidgin English Poem By Chidi Anthony Opara)
Dat time for Naija
Soja people say
Dem wan give government
Back to politics people.
But dem no mean am,
All na lie lie.
Dem come bring two party dem
Come tell country people
Make dem dey join,
Country people come dey join.
Dem come dey do
Small small election dem.
As dem dey do dem,
Dem dey cancel dem.
Di soja people
Come bring two of dem friend
Make dem contest for di big election,
Di person wey win am
Na im go be Naija Presido.
Dem come do di big election,
Dat day na June 12.
Dem come cancel dat one again.
One of di soja people friend
Wey get plenty money
Come talk say na im win.
Money come begin waka,
People wey dey find dem bele
Come begin dey waka,
Wahala come show.
Di soja people friend
Come call im sef Presido,
Soja people grab am,
Put am inside prison,
Di man come die inside prison.
Since dat time for Naija,
Election dey come,
Election dey go.
Presido dey come,
Presido dey go.
Still every year
People wey dey find talk
Go dey talk June 12.
Make I ask dem;
June 12?
Wetin?
Reproductions in part or in whole, in whatever forms, of ChidiAnthonyOparaPoetry/Quotes, published as social service, except for non-profit information and education purposes, without a written permission from PublicInformationProjects is not allowed.